Facebook

Wednesday, July 6, 2011

Richard Mofe Damijo is 50!


Yes o! One of the leading Waffarians, his excellency Mr Richard Mofe Damijo turns 50 today the 6th of July. Oya my people 50gbosas for oga bros! Abi e easy ? How many people fit act like the man, abi na today? Bros Richard don dey hold him own for long time as per Warri no dey carry last. Oga bros I hail o! May your dayses be long! Make Kerosene no ever finish for your stove o! I use this opportunity to join everybody in wishing you a very happy happy birthday.

5 comments:

  1. This your hailings na wa oh
    Abi d guy na your broda? LOL

    Okay, i get to gree say d bobo dey.

    im face oh ....100%;
    im Height oh ...100%;
    im Carriage oh....100%....
    even im spoken English....100%

    ReplyDelete
  2. Gbam!@Naijamum you get am. RMD no dey carry last at all... By the way I love your Pidgin

    ReplyDelete
  3. D bobo fine shaaa!

    shine shine bobo!

    Thanks for coming over to my place..welcome to blogsville.

    ReplyDelete
  4. As u add another year in ur life mofi may d almighty God guide,guard n protect u n ur family Amen.Congratulations!!!.

    ReplyDelete
  5. RMD una na heavy bros o! Happy Birthday

    ReplyDelete

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...